From the recording Ọ̀mọ̀nílẹ̀

Lyrics

See the truth of life na to live without fear o Abami Ẹda lo sọ bẹ gan gan gan ejule!
(See the truth of life is to live without fear says Abami Ẹda , throw it open!)
Eju eju eju eju
(Throw it open)
Ejule……
(Throw it)
Weitin bring this talk for the matter wey I wan yan o I go let you know
Wo wo wo wo
I go let you know ….
See the way Africa be today everything jagajaga yamayama scatter scatter jagbajagba no be so dem ancestors want am oo
Everything rederede scatter scatter jagbajagba no be so God want am o
But the painful thing be sey anything wey dey spoil Africa today look front look back look up look down
Na Africans hand dey for there
If e no be dem with òyìnbó
E go be dem dem wey dey for government
Dem dey spoil dem dey kill dem dey ruin
Motherland ooo oh oh motherland o ooo
Ejule!
Any disease at all at all
Weather na coronavirus abi ebola
Wey dey kill Africans today look front look back look up look down
Na Africans hand dey for there
If e no be dem with òyìnbó
E go be dem dem wey dey for government
Dem dey spoil dem dey kill dem dey ruin
Motherland ooo oh oh motherland o ooo
Ejule!
Eju × 11
Ejule!
E don tey wey e be like that o
E don tey wey motherland be like that o
But the truth of the matter be sey shey e go better o o
Make we ask ourselves sey how e go better o
See the people wey suppose be leaders of today
Dem dey fear dem dey run because
You no wan die
You no wan quench
Yiya no wan stand
To fight for the right
This African boy
You too dey fear
He go sey mama o na em teach me to fear o
Horns…
She go sey make we leave the fight for God o
She go sey na so God want am o
She go sey make we just dey pray e go better o
Mama oo na em teach me to fear like this o
She go sey make we leave the fight for God o
Agbarigida gida gida gida o gida gida ×3
Zoooom spiritual!
Zoooom maribochaaaaa
Hey!
Agbarigida gida gida gida o gida gida
Mama o na em teach me to fear like this o
She go sey make we leave the fight for God o
Spiritual!